Wetin happen for English Premier League today with Highlight
For di matches wey dem play fo EPL today, almost all di teams wey dey for home win dia game wit plenty goals sef. Na only one team dem con beat for home.
Na di results bi dis:
Chelsea vs Wolves
Since Chelsea don change dia Manager e bi like say dia game improve as dem don dey show dia muscle well.
Anoda win for dem na today wey dem crush Wolves 3-0 dis afternoon for Stamford Bridge.
Na Harvetz, Pulisix and Broja gather bodi do Wolves strong tin.
Newcastle vs Brentford
Today na shower of goals for teams wey dey home as Newcastle no get pity untop Brentford at all.
Newcastle first drop 2 goals before Brentford return 1.
Na wetin vex Newcastle to add anoda 2 join before Pinnock score own goal against him team (Brentford) to make di goals con bi 5-1.
Bournemouth vs Leicester
Leicester dey part of di teams wey see shege today.
Leicester wey bi say na dem first score for 10 mins for di game collect 2 goals for Bournemouth hand for inside second half.
Di game finally end for 2-1 as Billing and Chritie score for Bournemouth for 67 mins and 71mins.
Man-City vs Southampton
Haaland as usual still mark register for today game o, join Foden, Mahrez and Cancello.
Na serious beating dem give Southampton as di game end for 4-0.
Brighton vs Tottenham
Na only dis game naim bi game wey away team win for today EPL game.
Tottenham show Brighton say dem no bi mate as di only goal for di game enta fron Harry Kane hand.
Comments
Post a Comment