Real Madrid allow Liverpool dance first before dem tear Anfield into pieces
Liverpool fans wey enta coma yesterday go pass wetin di hospitals wey dey di city go fit handle. Match start for dia favor as dem don already score 2 goals inside 14 minutes. For dia mind, "di road don clear!" Madrid allow dem perform finish as dem dey settle to enjoy do fruit of dia labor like dis, naim Madrid begin pump dia eye wit goals. Madrid no stop until dem make sure say na 5 beta goals dem load Liverpool. Liverpool no believe am, e bi like juju for dia eye. Vinicius Jnr start di goals for Madrid wit him fine strike before dem open floodgates of goals untop Liverpool head. Madrid use dat one show dem say no bi only for final we fit flog una o. Even for Anfield, we go flog una like who no get papa. Highlight dey here so