Mbappe miss penalty as dem later carry am comot field ontop injury for dia win on wednesday

 Paris Saint-Germain don retain dia leading as oga of di table for di 3-1 win wey dem win against Montpellier on Wednesday.



But e wan con bi like say dia evening dull as dia star man, Kylian Mbappe carry injury for di game.

Mbappe see penalty for 8 minutes wey Montpellier keeper, Benjamin Lacomte catch as him second attempt still no enta after di referee say make him replay the penalty.

As first half dey near middle naim Mbappe limp comot as e signal him PSG people make den change am sharply. E bi like say na hamstring injury di guy jus carry so and dia UEFA Champions League game against Bayern Munchen go happen for two weeks time.

Na just one game PSG don win for dia last four games. Dia game yesterday still cost dem Sergio Ramos wey still carry injury and dem disallow 2 of dia goals before Fabian Ruiz score to make sure say dem dey front for inside 10 mins for second half.

Small time after naim Ruiz set beta pass for Messi wet score to make am 2-0 before 16 year old, Warren Zaire-Emery seal di win for dem for stoppage time afta Arnaud Nordin, Mbappe friend wen dem bin dey togeda for France national training academy, score for Montpelier.

Di game end for 3-1 in favor of PSG.




Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal