Posts

Happy New Year

Image
 We dey use dis opportunity thank all of una wey don dey support us since we start till today. Dis new year go pay all of us and beta tins go shelle for us for dis new year. God go run am for us.

Ronaldo don sign for Saudi club for €200m contract

Image
 Ronaldo don sign two year contract with AlNassr club for Saudi Arabia. Dis one come afta C.Ronaldo comot for Man U afta di interview wey him do wit Piers Morgan unto say im no like how Dem dey do am for Man U and say him no respect Ten Hag wey bi Man I manager again. Ronaldo don bi free agent since den and Saudi Arabia club, AlNassr see big opportunity to sign di superstar and Ronaldo sef no dull am as no oda club go like dey interested for him mata. Di club announce di mata untop Twitter for Midnight as many pipo don dey drop Wetin dem tink about di mata. But anyhow you see am, Ronaldo don dey near 40 years and dis move make sense for am unto say di money heavy.

Darwin Nunez no pick Messi or Ronaldo as him GOAT player

Image
 Darwin Nunez don yarn say him prefer Mohammed Sallah pass Messi or Ronaldo wey everybody dey shout upandan. Di argument of say who bi GOAT between Messi and Ronaldo don dey go on now as di two of dem don dominate football for over 10 years plus now. Salah dey part of di best players for English Premier League as we dey yarn so and naim bi di African man wey don score pass for Premier League history. Nunez don add him own join di argument as him support him Liverpool team member say na dat one him sabi as GOAT. For inside di video wey dey trend online, Dem ask am say, Messi or Ronaldo, Nunez smile small, look di interviewer, rely say 'Salah'

Mbappe say him wan make PSG sell Neymar if Dem wan make him remain wit dem

Image
 Neymar wey collect golden boot for di 2022 world cup wey jus finish for Qatar don yarn say him want make di club sell Neymar as part of di condition wey di club must fulfill before him go fit decide say him wan stay wit dem. Mbappe and Neymar get kwanta wey con make Mbappe tell di club say him no fit stay for di club if Neymar still dey dia. Mbappe still get 2 years for him contract after di guy agree to extend him contract wit di club last summer. Di guy no happy wit di club as dem no do wetin dem tok say dem go don wen dem renew him contract. Anoda condition bi say, Mbappe wan make di club remove di manager wey dey dia now, Christophe Galtier wit Zinadine Zidane wey no get any work for now. Him numba 3 condition na say make di club buy Harry Kane wey dey play for Tottenham as e bi like say Mbappe go like share dressing room with di English man for Paris.

Ekiti State Governor don yarn say im go improve di 4 mini stadiums wey dey di state

Image
 Di Ekiti State Governor, Biodun Oyebanji don yarn say him don ready to support sports mata as him tok am during campaign. Say all di necessary tins wey suppose make sports sweet make more pipo for take enta di game for Ekiti including Women, say him administration go make am happen. Him say, di 4 mini stadiums wey dey Ado, Ikere, Ijero and Ikole naim dem go work on to make am dey up to international standard. Him tok say all di equipment wey dem need him go provide am as sports don turn to ogbonge mata for di world to develop youth quick quick. Kunle Adeyemi wey bi General Manager for Ekiti State sports council don appreciate di Governor say him like how di Governor take start so, e mean say him get beta mind to make sports make sense for di state.

Premier league: Yesterday results

Image
 Na yesterday English Premier League resume again afta world cup break wey start for November, 2022. Di result of di games wey happen yesterday Brentford vs Tottenham: Brentford no joke o, na dia game bi di numba one game wey fess happen afta di world cup break. Brentford first give Tottenham 2-0 before Tottenham con sabi say "e bi likeEPL don start o. Bi like say we dey sleep." Na so Harry Kane score first one for Tottenham before Hojbjerg finally equalize to make am draw. Southampton vs Brighton: Southampton collect from dia own house as  Brighton drop 3 hot goals for dia lap. Southampton even dash Brighton goal. Di second goal na own goal wey make di total goal for Brighton bi 3 for di game. Leicester city vs Newcastle: Leister sef hear am for Newcastle hand as Newcastle flog dem for dia home. Na wood first nak dem 2by2 plank for neck before Almiron and Joelinton finish dem up. Crystal Palace vs Fulham: Na so Crystal Palace sef collect wotowoto for Fulham hand. Apart form ...

Premier League dey resume today wit di usual Boxing day games

 As una know say na tradition for England say dem must play game boxing day. Dem no dey carry am play. Na di games wey go happen today bi dis. Brentford vs Tottenham. 2pm Southampton vs Brighton. 4pm Leicester city vs Newcastle. 4pm Crystal Palace vs Fulham. 4pm Everton vs Wolves. 4pm Aston Villa vs Liverpool. 6:30pm Arsenal vs Westham. 9pm