Premier league: Yesterday results

 Na yesterday English Premier League resume again afta world cup break wey start for November, 2022.


Di result of di games wey happen yesterday


Brentford vs Tottenham:

Brentford no joke o, na dia game bi di numba one game wey fess happen afta di world cup break.


Brentford first give Tottenham 2-0 before Tottenham con sabi say "e bi likeEPL don start o. Bi like say we dey sleep." Na so Harry Kane score first one for Tottenham before Hojbjerg finally equalize to make am draw.

Southampton vs Brighton:

Southampton collect from dia own house as  Brighton drop 3 hot goals for dia lap.


Southampton even dash Brighton goal. Di second goal na own goal wey make di total goal for Brighton bi 3 for di game.

Leicester city vs Newcastle:

Leister sef hear am for Newcastle hand as Newcastle flog dem for dia home.


Na wood first nak dem 2by2 plank for neck before Almiron and Joelinton finish dem up.

Crystal Palace vs Fulham:

Na so Crystal Palace sef collect wotowoto for Fulham hand.


Apart form di goals wey den collect, Dem still collect red card for referee hand join.

Everton vs Wolves:

Wolves sef plan go Everton house as dem make sure say di 3 points wey dey di game, na dem collect am!


Everton fess score inside 7 mins before Podence score for Wolves to equalize di game, and for 90+5, Nouri run dem street.

Aston Villa vs Liverpool:

Liverpool sef follow di trend wey happen yesterday as e bi say almost all di away teams naim win dia match yesterday.


Salah and Van Dijk fess score for Liverpool for first half before Watkins drop one for Villa as Bajcetic  con score di final goal for Liverpool for inside 81 mins to make am 1-3 in favor of Liverpool.

Arsenal vs Westham:

Plenty pipo bin don predict say wen World cup break end, Arsenal go don taya, say na so dem dey do.

But e bi like say dis Arsenal different from di one wey we bin know o.

Arsenal clear Westham 3-1.


Westham go rush score as dem see penalty inside 27 mins, na so Arsenal rush dem for second half like who tiff.

Saka, Marttinelli and Nketiah, na dem run di level for di gunners.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal