Posts

Madrid come England come revenge

Image
 This week plenty tins happen for inside Ueda Champions League Quarter finals as Madrid and City jam again for di second leg. We go remember say di first leg wey dem play for Madrid house end for 3-3 draw as Manchester City drag am with Real Madrid untop who wan enter Semi final for two of dem. Even as e bi say na Manchester Real Madrid come, dem still make sure say dem struggle qualify. But City show dem say, even if una to win, una to almost 'kpeme'. Dem drag di mata reach penalty before Madrid flog City comot for inside UCL for dis season after dem don play 1-1 for full time and extra time.

Who don score goal pass for 2023

Image
 BR football drop post untop dem X account to take show di players wey don score goal wey many pass for dis year 2023 wey we dey so. Cristiano Ronaldo wey dey play for Al-Nassr and Portugal naim carry first for di mata wit 40 goals so far for di year. Erling Haaland wit   Man City and Norway don score 39 goals so far. Dis one make am bi second untop di mata. Kylian Mbappe wey dey play for PSG and France don score 35 goals for inside 2023 so.

Man City destroy Real Madrid for Etihad

Image
  Manchester City vs Real Madrid. Yesterday night game between Manchester City and Real Madrid make us know say, no bi say Arsenal no try o, but did Man-City team bi like evil spirit. Den no dey fear elders. Do way dem take flog Madrid last night I sure say Madrid pilot fit miss road go Russia instead of Spain. Erling Haaland try for di game but e no see any goal. Den don too focus on am. Na 4 hot goals City pour for Madrid lap last night. Wey make City qualify for Final of 2023 UCL wia den go play wit Inter Milan. Bernardo Silva naim score di First two goals for first half before Akanji drop di third one and Alvarez seal am up to man am 4. Do mata com mame Real Madrid bi like Fake Madrid. We highlights for here. https://youtu.be/3Xx0H3OCE3o

Night of Decision: Man-City abi Madrid?

Image
 Night of Decision Manchester City vs Read Madrid (UCL Semi Final Second Leg) Na dis nite, who go join Inter Milan for dis year Uefa Champions League final go sabi himself. Di game tight somehow as di two teams get 1 goal each. Manchester City go wan use advantage say dem dey home take make sure say dem qualify enta final and Madrid too no go wan gree. Dis game go tough because, Manchester City coach, Pep Guadiola dey hope to carry di first Champions League trophy for the club. Di club don try for dis season as dem don flo Arsenal comot for top of di English Premier League and dem get hope to smell Champions League final again dis year afta Chelsea run dem street for 2021 to win am for dia hand. Madrid for di oda side go wan win am back to back and to make sure say dia UCL number enter 15. Last year wey dem win am make am 14 times but if dem fit win am dis year, e go turn 15 times. Dem go wan show say na dem bi di real Idan.

Tottenham go decide Conte future in the next 48hours

Image
 Antonio Conte believe say some players dey wey like to dey dia comfort zone, even if na Angel Gabriel bi di coach.  Conte still believe say if di future for any club no align, di club no go fit make am. Gist dey street say e go hard for Conte to continue as Tottenham head coach after di guy para anyhow afta dia 3-3 draw wit Southampton on saturday. Informate from pipo wey near Conte come out say, Conte no tok wetin him tok on Saturday because e wan make Tottenham sack am but him tok am unto say di mata don dey him belle for long and nor bi to make any player feel anyhow. Na end of di season Conte contract go end but as tins bi now dem fit show di guy exit before dat time. As international break dey dis weekend, Conte don go back to him house for Italy to go relax. Di guy dey always try to sharply align wit him winning mentality but him dey disappointed say him neva see am do for Tottenham.

Wetin dey happen for La-Liga table

Image
 Na here we dey o, make we update una about how table bi for Spain as we dey tok so. Wit dia winning on Sunday, Barcelona don use long pole create gap between dem and Real Madrid as na 12 full points dem take dey lead for untop table now. Barcelona dey cruise untop wit relax mind. Celta Vigo hold di table for middle inside 10the position as Mallorca dey number 1 for di second half of di table. Di gang of Valencia, Almeria and Elche na dem dey bottom of table dey plan how dey wan run dia relegation party!

La liga for weekend (Sunday)

Image
 Dis weekend wey jus pass so, make we use dis one touch light wetin happen for Spanish football. Real Betis vs Mallorca: Real Betis flog Mallorca wit jus one goal to secure 3 points for dia home. Di goal enta 3 mins after dem enta second half as Iglesias Quintas put am for Mallorca bodi. Osasuna vs Villareal Even   as e bi say na Osasuna dey home, Villarreal still use dia eye see shege. Na Chukwueze fess start am wit him goal for inside 14 minutes. Na after game dey near to close Morales sef drop him own, but dis time na double di guy drop. One for 85mins and do oda one for 90+3mins. Di game end for 0-3. Sociedad vs Elche Sociedad show Elche say, oga, naim den dey call 'master'! As dem flog di visitors 2 goals to nothing. Di game bin dey barren of goals for first half but as second half start, Kubo end di barrenness as Barrenetxea top am for 90mins to seal am for 2-0. Getafe vs Sevilla: Getafe   welcome Sevilla come dia home to come give dem small beating to secure dia 3 points