Tottenham go decide Conte future in the next 48hours
Antonio Conte believe say some players dey wey like to dey dia comfort zone, even if na Angel Gabriel bi di coach. Conte still believe say if di future for any club no align, di club no go fit make am.
Gist dey street say e go hard for Conte to continue as Tottenham head coach after di guy para anyhow afta dia 3-3 draw wit Southampton on saturday.
Informate from pipo wey near Conte come out say, Conte no tok wetin him tok on Saturday because e wan make Tottenham sack am but him tok am unto say di mata don dey him belle for long and nor bi to make any player feel anyhow.
Na end of di season Conte contract go end but as tins bi now dem fit show di guy exit before dat time.
As international break dey dis weekend, Conte don go back to him house for Italy to go relax.
Di guy dey always try to sharply align wit him winning mentality but him dey disappointed say him neva see am do for Tottenham.
Comments
Post a Comment