La liga for weekend (Sunday)

 Dis weekend wey jus pass so, make we use dis one touch light wetin happen for Spanish football.


Real Betis vs Mallorca:

Real Betis flog Mallorca wit jus one goal to secure 3 points for dia home.



Di goal enta 3 mins after dem enta second half as Iglesias Quintas put am for Mallorca bodi.


Osasuna vs Villareal

Even as e bi say na Osasuna dey home, Villarreal still use dia eye see shege. Na Chukwueze fess start am wit him goal for inside 14 minutes.


Na after game dey near to close Morales sef drop him own, but dis time na double di guy drop. One for 85mins and do oda one for 90+3mins.

Di game end for 0-3.


Sociedad vs Elche

Sociedad show Elche say, oga, naim den dey call 'master'! As dem flog di visitors 2 goals to nothing.


Di game bin dey barren of goals for first half but as second half start, Kubo end di barrenness as Barrenetxea top am for 90mins to seal am for 2-0.


Getafe vs Sevilla:

Getafe welcome Sevilla come dia home to come give dem small beating to secure dia 3 points.


Na inside second half di goals action start as Munir launch first goal for 50 mins before Unal end am before di referee blow final whistle.


Barcelona vs Real Madrid:

Di major game wey no gree anybody sleep for Spain for weekend na between Barcelona and Madrid.

Everybodi blood don hot down even before game start. Na dia Araujo go dash Madrid go as him score own goal.

Madrid don dey jubilate wit one side but dem still dey hustle for goals cos for dis kain game, 1 goal no dey reach. Before first half finish, for 45 mins naim Roberto score for Barcelona to take pay back di gbese wey Araujo dey owe. 

Nobodi gree for each oda among dem but for 90+2 mins, Kessie drop winning goal to give Barcelona 3 points for di game.



Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal