Champions League: Wetin happen yesterday night

 For  group E.


Chelsea vs RB Salzburg.



Chelsea bin think say dis one suppose pure for dem as last week no too make sense. 

As time enter 48 mins, na so Sterling score for Chelsea and for dia mind, E Don Soft but Okafor for Salzburg dey one size dey laugh say, una never know natin!


As clock enter 75 mins, na im Okafor score o. Dis guy spoil Chelsea joy. Do me I do you, Man no dey vex for that one. Na so di mata take end.

Chelsea still dey hope say maybe or maybe not winning fit dey front!


AC Milan Vs Dinamo Zagreb.




As Chelsea dey sweat for one side, AC Milan dey chill unto say, 'AC dey dia body'.

Na Giroud (45mins) first open floor for the beating wey Dianamo collect, Saelemaekers (47mins) add im own join. Dianamo con bi like, no bi we win Chelsea last week? 'everybodi ginger'! Orsic (56mins) epp Dem score 1. See as dem jus get hope.

But elders go always be elders, na im Pobega (77mins) go carry koboko say, as we allow una score 1, we do bad abi? Oya chop koboko!


Na so di game take end for 3_1 in favor of AC Milan.


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal