Champions League: Wetin happen yesterday night
Group G.
Man. city Vs B. Dortmund
Dis na one of di hot games wey happen last night. Dortmund first vex score! Bellingham (56mins) Omo, Man city eye red! 'which kind wahala be dis' Man city con dey use faith and prayers take guide
As do game near to end like this, for exactly 80 mins, J. Stones jus go carry catapult, put stone inside, shot am enter Dortmund body. 1-1.
Dortmund con dey console dem self say no shaking, game still dey!
Before Dem talk am comot for mouth, Halaand (84mins) halla dem another one.
Na Wetin make Borussia Dortmund come cool down say, 'gentility no bi stupidity'.
Na so di game end for 2_1 wey favor Man City.
.jpeg)

Comments
Post a Comment