Dem don tell Man U say, una nor fit win anytin wit C. Ronaldo wey dey dat una team

 Christiano Ronaldo nor too get luck for dis Man U wey e come dis time so. Since di guy join Man U and especially dis new season, e never dey try as Ronaldo wey we bin know before.



Na only 3 match Eric Ten Hag wey bi Man U coach, don use Ronaldo for dis season as im prefer to use Marcos Rashford for front instead.

Man U wey bi say na Man City wey bi dia rival dem go meet afta International break finish.

Dem don warn Man U say, shi shi una nor go see if Ronaldo still dey dat team. 

As e bi say e nor too play game dis season, na only 1 goal Ronaldo don see score against Sheriff Tiraspol for Europa League.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal

Wetin happen for English Premier League today with Highlight