Dem fit deport Thomas Tuchel commot United Kingdom o

 Di new Brexit rule fit affect Thomas Tuchel so as e bi like say na 90 days im get to comot for United Kingdom.


Tuchel wey bi say dem sack am for early September con replace am immediately with Graham potter.

Di join bodi untop football mata for UK neva decide how Tuchel mata go take bi. Na dem go get final stamp for di mata to know if Tuchel fit stay pass 90 days or not.

Di guy dey hope now as e never hear wetin di final decide go bi ontop di mata.

Tuchel wey bi German man fit get issue unto di new Brexit rule wey make everybody need visa to work for inside UK. Tuchel bin dey work with one post Brexit governing body endorsement visa but as e bi say dem sack am, im get only 90 days from di day wen dem sack am to comot for di country.

Na for January, 2021 dis visa for comot wey tok say every bodi wey go work for UK must get dis particular kpally as e bi say UK don comot for European Union.

Tuchel still dey live for London near Cobham wia Chelsea training base dey. Im pikin dem still dey go one school for Surrey as  e dey reason how matters go bi for am.

E fit bi say na Bayern Munich and Juventus Tuchel dey observe as dia performance no to dey ok for now, maybe work fit from dia show!

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal