EPL: Wetin happen for today game

 Wolverhampton Wonderers vs Manchester City



Man City nor dey smile at all o. Dem go Wolves house go roast dem, dem nor even allow wolves breathe at all na from di first minute di flogging start.

Na back to back jus dey drop di goals as e dey hot. Wolves cool down chop 3 goals for Man City hand dis afternoon.

Na Grealish (1min), Haaland (16mins) and Foden (69mins) join bodi take cause di kasala untop Wolves head.


Newcastle vs AFC Bournemouth


Na draw dis mata take end o. Na Billing firs open floor wit goal for 62 mins before Isak return am for 67mins after foul happen wey lead to penalty for dem.

Di two of dem get strong head. One no gree bow for di oda.


Tottenham vs Leicester



Na rain of goals dis evening as Tottenham vex say why Leicester go fess dem score.

As di goal enter from Leicester, Na so Tottenham go open store of goals. Fire Leicester 6 without looking back as Leicester struggle to get two befoe di mata end.


Na as EPL table dey dis evenin bi dis so.


Na for goal.com dis table from come.




Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal