EPL: wetin happen yesterday

 Una welcome again to dis fine Saturday morning as EPL don resume dis week.


Yesterday night, 2 games happen.

1.  Aston Villa vs Southampton.



Southampton go Villa house yesterday go  chop koboko as villa show dem say dem no bi mate. Di goal from Villa enter for 41 mins inside first half.

Match details dey here so.



2.  Nottingham Forest vs Fulham

No bi smal tin for Nottingham yesterday as dem struggle wit Fulham to make sure say dem win for home, but as agba wey Fulham bi, dem say, e no go happen!

Na so dem drag Nottingham for dia own Forest o.



Awoniyi (11mins) open floor for Nottingham as dem lead for first half, for dia mind, e don soft!

As second half start, Fulham don go charge dia battery, con dey score back to back like say na monkey post dem dey play. 3 goals enter inside 6 mins. Nottingham shock say, shoo!

Dem hustle try see if miracle fit happen but na only one dem fit add join to make am 2-3.

Las las. Fulham win dem.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal