Europa: Wetin happen yesterday.
Na di tori of wetin happen for some of di matches for Europa yesterday bi dis.
Roma vs HJK Helsinki
Roma no smile at all as dem show HJK say, dem no bi dia mate, Roma use 3 solid goals take wounjure HJK sotey, dem sinki as dia name bi.
Na Dybala, Pelegrin and Belotti join bodi take cause di kasala.
Sheriff vs Man U
As Man U no qualify for Champions League so, dem wan try show Europa pipo pepper.
As dis na C. Ronaldo first Europa, di guy sef mark register wit goal (pk) for inside di game wia dem show Sheriff say Oga na master.
Sancho and Ronaldo join bodi for di woundment wey Sheriff collect to make am 2 wey Man U take win dem so.
Braga vs Union Berlin
Di two of dem bin fight tey as Braga no wan gree, Union Berlin sef say dem get coconut head.
Las las, na Braga still con collect di shine o as dem see one goal smuggle enter for 77mins before di game end.
Na Olivera nai do di magic wey make Braga finally fit brag untop di mata.
Real Betis vs Ludogorets
E get dis game bi dat yesterday. Real betis bi don show say dem na senior men but Ludogorets sef get strong head.
Real Betis don score 2 goals for 25 and 39mins, Ludogorets return 1 before half time, Betis con still add anoda for 59mins to prove levels, as clock enter 74, Ludo pipo sef score dia own, na so dem drag di mata till, Betis con finally use one goal lead dem to win di match yesterday.
Olympiacos vs SC Freiburg
No bi small mata yesterday o as Freiburg use Olympiacos head mop ground.
Dem score di first one, e nor reach dem, dem put di second, con still add di third goal.
Dis one na massacre dem dem massacre Olympiacos for Olympiacos house o.
Bi like say e get wetin Olympiacos don collect for Freiburg hand before.
Qarabag vs Nantes
Qarabag no even smile at all, dem jus nack dem Nantes 3 goals. Dem no even allow dem see 'natin' for di game.
Dem first pity Nantes for first half, as second half start like dis. Den use goals scatter Nantes mouth.
.png)






Comments
Post a Comment