Paul Pogba broda Mattias Pogba don enta gbege as e try wan use scope and force collect €13m
- Get link
- X
- Other Apps
Mattias Pogba wey bi Paul Pogba senior broda and still professional for Guinea football bi like say e dey work wit dem criminal organization.
Prosecutors say e dey demand €13million from im broda, Paul Pogba and im twin broda Florentin wey dey play for Indian Super League Club, ATK Mahun Bagan.
Three of dem don land for prison and di last one never evenin show for judge front.
All of dem don deny say dem no kidnap and dem no blackmail but dem gree say dem dey pressure di footballer.
Dem still talk say anoda group wey dem no know dey threaten dem wit violence.
Dem attack two of di pipo wey dem accuse wey dia name na K. Brodas. Dem shoot one for hand for August.
Paul Pogba bin don complain last March for Italy and France say some pipo dey try force am to pay €13million wen dem attack am for Roissy-en-brie for outside Paris.
As prosecutors dem tok, two men wey cover face demand €13million for Paul Pogba.
For many months, di group don dey harass and pressure di guy sotey last month e send €100,000 give dem.
Mattias, wey bin come out for August com tok say im get "shockin reveal" wey e wan reveal about im broda and Kylian Mbappe.
Im tok say im broda go pay winch make e for use juju ontop Mbappe head but Paul Pogba don deny di mata say na big lie.
Di judge wey dey untop di mata still dey reason if im go give di pipo wey dey prison untop di mata bail or not.
- Get link
- X
- Other Apps
Comments
Post a Comment