Tobi Amusan, Ese Brume don meet with President Buhari as e dash di team 200million naira

 Di President of Naija, Buhari don give team Nigeria 200 million naira as dem do well for commonwealth games.



Dem still give dem different honor to show say dem don get level for di country

As Femi Adeshina wey bi talk talk for di President yarn, E say Pressy don put hand say make dem share 200 million naira give all of dem wey represent we country.

Na on Thursday of dis week wey dey fold carpet go so Pressy give dem di award for inside Aso villa for Abuja.

For di competition, Naija win 12 gold, 9silver and 14 bronze medal wey make di total medal bi 35 wey dem collect.

For all di African country wey show for di game, na Naija try pass. On di overall medal table, Naija bi no 7.

 Buhari award Tobi Amusan wey win gold for 100m hurdles con still break record wit  Officer of the Order of the Niger OON.



Other athletes wey win medals for di game; Ese Brume, Blessing Oborodudu, Oluwafemiayo Folashade, Taiwo Liadi, Ikechukwu Obichukwu, Bose Omolayo, Favour Ofili, Nasiru Sule, Ifechukwu Ikpeoyi, Ebikewenimo Welson, Hannah Reuben and Elizabeth Oshoba,still  follow collect National award.


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal