Wetin happen for di Uefa Nations League games yesterday
For di games wey dem play today for Uefa Nations League.
Na di scores as e take happen bi dis so:
Austria vs Croatia
Croatia wey dey League A don show why dem bi baba o, as Austria collect wotowoto fo dia hand yesterday
As Modric open di game wit goal for 6 minutes, Baumgarter for Austria sef return am, di mata con dey tough as no bodi gree bow, but aa e enter 69 minute, Livaja add
Denmark vs France
Odogwu nor bi for name alone, na action dey run am pass. Na wetin Denmark show france yesterday bi dat for dia game wey end wit say, France chop beta beating.
Dis kain tin no too dey shock again cos na football and anytin fit sup!
Netherlands 1:0 Belgium
Dem bi no wan gree for each oda unto say, you big, me sef big but las las, na one person bi bigger person.
Van Dijk show dem Eden Hazard pipo say na dem bi bigger person o as e run go enta for 73 minutes.
Wales 0:1 Poland
Na so Poland go Wales 'poling' unit go mess dem up for dia.
As Poland win dem so, e mean say Wales don relegate go League B for Nations League so.
Swiderki naim make di goal happen inside 57 minutes. As Wales drop, Poland survive.
Faroe Islands vs Turkiye
Faroe Island first drop 2 hot akara inside Turkiye bag within 7 minutes before Turkiye try return 1 before match end.
Na Gurler return 1 back to make di game 2-1 for di end.
Luxembourg 1:0 Lithuania
Di 2 teana wey dia name start wit 'L' no wan gree take 'L' for di game, dem drag am sotey...
Na for 89 minute Rodrigues use byforce give di 'L' to Lithuania as di game end for 1:0
Azerbaijan 3 : 0 Kazakhstan
Nor bi small flogging Azerbaijan flog dis pipo o. Dem jus dey measure di goals like who dey measure garri. No chilling from Azerbaijan at all.
Na from 66 minutes wey Morochkin score own goal for Kazakhstan di wahala start.
Slovakia 1:1 Belarus
Even do dia name na SLOvakia no mean say dem no go score o but dem fit slow score. As Belarus nak dem 1 for 45 minutes, dia eye clear.
20 minutes afta, dem sef do dia own back as first to do, no dey pain and do me i do u no suppose cause fight.
Andorra 1:1 Latvia
Na close to di end of di game Latvia drop dia own to to make am draw.
Moldova vs leichtenstein
Leichetenstein bin don dey shout hallelujah as di game enta 90 say na draw e go end but 'dey nor see wetin dey front dey come'.
Na inside di extra time within 2 mins di 2 goals enta.
Dis updates na from skysports.com we gada dem for una
You are doing well
ReplyDelete