Arsenal loss to PSV expose some kain tins wey Arteta dey worry about.

 PSV Eindhoven beat Arsenal 2-0 for dia match on Thursday for Europa league.

Di defeat show somtin about di gunners wey do like suwegbe truout di match.

If you look di team well, dem no get di kain strength and depth wey dey required to play for all competition dis season.

For di first time inside dis season, Arsenal con bi like relegation team for di game wey happen on Thursday.

Dis beating come from di hand of PSV Endhoven wey dia manager bi Ruud Vaan Nesteroy wey bi di former ogbonge player for Man-United dat year.



Di scoreline for worse pass as e bi if to say VAR no rule out 3 goals wey PSV suppose get.

Some Arsenal fans bin advise Arteta (Arsenal Coach) make e rest im best players as di guy don dey top table already for di group but im no gree, e still put all im players dia. Dis kain move show say dem no get depth at all.

As tins bi now, Man-City don dey hot and for Arsenal to fit compete well especially for Premier League, di Manager must reinforce di team make dem no go lose guard for Man-City to overtake dem.

Na dis season bi best starting season for Arteta both as Manager and even as player.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal