AS Roma suspend Ethiopian steward wey go take picture wit Osimhen afta Napoli flog AS Roma
E bi like say Matteo Leo Cicero don lose im job as steward for AS Roma afta dem see am say im go take pictures wit di same man wey fuck dem up for dia game against Napoli.
Di 18 years old guy happy as im see im football idol wey epp Napoli beat Roma for dat game.
Di mata pain persin wey bi oga for Roma steward say, how can? You wey dey work wit us go dey snap pics wit our 'enemy'
Osimhen wey bi man of di match for dat game last week sunday unto di kain ogbonge goal wey im score against Roma. Many pipo wey like football for di whole world don dey praise di guy unto how im take score di only goal for di match from angle wey dey impossible.
We see am say afta di match, Cicero near Osimhen, dem gist small before Osimhen and am take picture.
Na later gist con dey clear say na Nigerian Sports reporter, Oma Akatugba carry Cicero go meet Osimhen, na den we con still know say Cicero na Napoli fan wey see job with Roma.
Osimhen tell Cicero say make im no worry, make im give im numba to Oma Akatugba wey link dem up, say im (Osimhen) go sort am personally.
Comments
Post a Comment