News don dey fly around o, say Chelsea new owner, Todd Boehly yarn say den don finally agree to change di name of di club wey e don dey bear for over 118 years now to London Cowboys. From Go con bi Dis gist don scatter all social media dem including twitter wey e bi like say na dia di tin for hot pass. Oda big club fans don dey laugh Chelsea wit different name, Some say na Cow FC, Maalu FC, Animal FC and different names wey oda fans don plan to dey call Chelsea. According to di gist wey dey fly. Dis name go change from next season wey bi 2023/2024 season, Boehly even add say di stadium name go change to Boehly bowl. If dis name change turn real and dem no roast Chelsea fans especially for we obodo Nigeria, make i know wetin cause am!
For di matches wey dem play fo EPL today, almost all di teams wey dey for home win dia game wit plenty goals sef. Na only one team dem con beat for home. Na di results bi dis: Chelsea vs Wolves Since Chelsea don change dia Manager e bi like say dia game improve as dem don dey show dia muscle well. Anoda win for dem na today wey dem crush Wolves 3-0 dis afternoon for Stamford Bridge. Na Harvetz, Pulisix and Broja gather bodi do Wolves strong tin. Newcastle vs Brentford Today na shower of goals for teams wey dey home as Newcastle no get pity untop Brentford at all. Newcastle first drop 2 goals before Brentford return 1. Na wetin vex Newcastle to add anoda 2 join before Pinnock score own goal against him team (Brentford) to make di goals con bi 5-1. Bournemouth vs Leicester Leicester dey part of di teams wey see shege today. Leicester wey bi say na dem first score for 10 mins for di game collect 2 goals for Bournemouth hand for inside second half. Di game finally end for 2-1 as Billin
Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal and im problem for Manchester United no go affect dia hope for world cup naim teammate Joao Mario yarn dis one. Di superstar wey blast Manchester United for interview wey im do before world cup start tok say, di club fall im hand and im no get any respect for Man-U manger, Erik ten hag. Ronaldo wey bi 37 years don readi to lead Portugal for di world cup wey dey happen for Qatar and e bi like say naim last world cup bi dis. Ronaldo dey always dey happy wen e dey National team Joao Mario wey bi Benfica midfielder tell Reuters afta dia tainig for Lisbon. "I see am yesterday and e dey very fine as e sey always dey" e even tell me say "im happy to dey here" and im focus na on di national team
Comments
Post a Comment