C Ronaldo naim bi di first player wey go score 700 goals

 Christiano Ronaldo don prove am again say im na on of di goal scorers wey get level pass since ball mata start for dis life.

Im show am for dia match against Everton on Sunday wen Ronaldo score to make im club goals 700. Im score for 44 mins inside di game to make sure say Man-U dey Infront.

Dis goal na Ronaldo second goal for dis season and I'm first goal for Premier League dis season as di season neva really favor di guy like dat.

Di guy no really dey dey game as Man-U coach, Ten Hag, no really dey use am for inside match.

Even for dis match so wey dem go Everton go play, Ronaldo no start, na Anthony Martial wey dem remove unto say di guy collect injury make Ronaldo fit enta and di enta wey im enta con make sense.

Afta game start for 5 mins, Iwobi bin score for Everton as e con bi like say na beating Man-U go collect.

Anthony score for 15minute and Ronaldo seal am for 44mins.

Fans and everybodi wey concern don dey congratulate Ronaldo since.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal