Champions League match day!

 Today na today o as anoda Uefa Champions League match dey happen dis evening across Europe.

Different teams go dey hustle points today and tomorrow make dem for join teams wey go qualify go next round.



Some teams don get peace of mind as dem don already win 3 games, some mind still wan cut as e bi say dem neva know how tins wan bi.


Di games for today na;


AC Milan vs Chelsea.    08:00pm

Chelsea go go Milan dis evening to see if dem go fit continue dia winning to take move from second to first ontop dia group table as AC Milan sef go try to win make dem sef for fit go up comot for 3rd position

PSG vs Benfica.    08:00pm

Dia last game, PSG bin dey front until mistake happen and dem score demself own goal to make 1-1 last week. As PSG dey home, dem go try say make dem see 3 points round am up to 10 and Benfica sef no go wan gree.

Dortmund vs Sevilla.    08:00pm

Dortmund sef go wan nak Sevilla as e bi na na only 1 point sevilla get and na Dortmund house dem dey go. Dortmund go wan win or draw highest 

Shakhtar Donetsk vs Real Madrid.  08:00pm

Shakhtar Donetsk go dey hope say make dem win Madrid or make e bi say den see draw. If dem lose, and Leizpig win, dem go go 3rd position bi dat.

Coppenhagen vs Man-City  05:45pm

Man-City go wan continue dia winning dis evening as dem no get anytin wey go worry dem as Coppenhagen no reach to give de issue

Dynamo Zagreb vs RB Salzburg   08:00pm

Salzburg go try make sure say dem win so dat dem go fit still retail dia top position. As na Zagreb home dem dey go, e fit hard small as dose ones sef go wan win. Di 3 points dey vital cos di gap wey dey between teams for dis group no wide at all.

Maccabi Haifa vs Juventus.    05:45pm

Maccabi mo jus de dis game at all. Dem neva even see 1 point. Juve go dey hope to use dem dem as bonus again dis evening.

Celtic vs RB Leizpig.     08:00pm

Dis 2 teams near each oda as one na 3rd di oda one na 4th. Leizpig still get hope, if dem win and Madrid win too, dem go dey second position

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal