Chelsea dey reason to sign one of di make sense forward wey dey Arsenal.

 Top teams for Premier League don dey eye Gabriel Martinelli of Arsenal.


Chelsea dey part of di club wey we believe say dem serious untop di 21-year old mata.

Dis tori dey show now wey bi say di Brazilian don enta top form for Arsenal dis season as e don score 3 goals for dem.

Martinelli don establish imself since dis season start. Arteta bin dey doubt di guy if e go fit perform well but di guy justify imself as e don already net 3 goals dis season.

Martinelli wey join Arsenal for 2019 dey collect £50,000 a week. But Metro UK talk say di guy don grow pass di deal as e bi say im performance don improve.

Arsenal dey ready to tie di guy down but dem go face serious competition as Chelsea no wan rest untop di guy mata.

E even bi like say Man-City and Liverpool dey part of di clubs wey stand for one corner dey observe di guy.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal