Chelsea Mid-fielders James, Kante fit miss 2022 world cup
Chelsea coach, Graham Porter don yarn say Ngolo Kante and Reece James go need see specialist wey go determine if dem go fit play for world cup or not.
James wey bi England right-back, limp comot for field as e injure for knee for di match wey Chelsea take win AC-Milan 2-0 on Tuesday as media pipo dey yarn say e go hard for di 22 year-old James to fit play for Qatar.
"Na dis weekend e go see specialist and before day time I go fit give any informate about di mata" na Wetin Potter tok about James wey don make imself first choice of England coach, Gareth Southgate as right-back.
Kante Neva play game since August wey im get hamstring injury. Kante dey important for how France take win for 2018 and e go bi big miss for Didier Dechamps side if di guy no later play.
Comments
Post a Comment