Governor Wike promise each Rivers united player $40,000 if dem fit qualify for beat Wydad

Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike don promise say if Rivers United fit win Wydad Atletic Club of Casablanca to qualify for CAF Champions League group stage. Im go sama each player wit $40,000 to put for pocket.


Di winner of Nigerian League go host Casablanca of Morocco on Sunday wey bi 9th October, 2022 for inside Adokiye Amiesimaka Stadium, Portharcourt for dia first leg for di match.

Na Barriater Chris Green represent di governor as di state government host di players dem.

"Di governor wey bi di club numba 1 fan say make i tell una say, im dey una back, infact, di whole of Rivers state plus Naija pipo dey una back"

"Unto di good heart of di governor, im don approve $20,000 for each player sake of say una win di League last season"

"Di governor still don promise say if una win dis Wydad game take qualify for CAF Champions League group stage, naim bi say $40,000 extra dey wait una o."

"So make una go prepare to make all naija pipo proud."

Di captain of di team, Austin Festus tank di Governor say, dem no go shame am and dem go justify di trust wey di governor put ontop dia bodi.

Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal