John Terry give uppercut response to Zimbabwe fan wey correct im english.
Former Chelsea defender, John Terry don reply one Zimbabwe fan wey try correct im English as John drop comment untop Man-City and Man-U match for weekend wey pass.
Di gist happen untop twitter wia di Zimbabwe fan wey im name for di popular social app bi pakuru.
Terry wey bi one of di best defenders for world wen e still dey play for Chelsea and Premier League.
Im don win plenty trophy plus include Champions League and Premier League titles dem.
As Terry drop tweet wey e even hail Halaand for inside, naim dis pakuru jump out 'pakurumo' Terry tweet o, say Mr Terry make i teach you English...
John Terry tweet say 'Na great small days for Qatar. Na joy as i see how Man-City finish Man-U today. City to good. How you wan take stop player like Haaland,i neva see im kain player before"
Na so Pakuru (Mr Sabinus) tell Terry say, "make i teach you English, na too good, nor bi to good"
Naim Terry tell am say "sorry o, but wen u dey school dey learn dis English, i dey win Premier Leagues"
Na so di guy zoom off o. E nor respond again. Plenty twitter pipo don dey console di guy since dat time.
.jpeg)



Comments
Post a Comment