Karim Benzena win Ballon d'or as Putellas win women own

 Karin Benzema don win dis year Ballon d'or wey bi reward of ogbonge game wey im play for Real Madrid. As Putellas sef win di women own. Dis award na for inside Paris for France dem give dem so.

Benzema wey bi di first French man wey go win am since Zidane don win am last for 1998, score 44 goals for 46 games for im club last season as dem win di UEFA Champions League and La-Liga.

Fifteen out of di goals wey im score na for inside Champions League e score dem as hat-trick enta for inside different games as dem win PSG, Chelsea and Man-City for knockout.

Na Benzena collect am afta Messi collect im numba 7 Ballon d'or  last year. Dem no nominate am for dis year own at all.

Na Sadio Mane collect second for di mata.


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal