Man-City naked Man-U for market square still flog dem join

 No bi small tin for Manchester dis afternoon as Man-City Naked Man U for Etihad Stadium.


Phil Foden and Erling Haaland naim cause all di wahala from Man-City side as Martial and Antony try make e bi say Man-U no waka comot Etihad wit total naked bodi.

Na from 8 minutes 'vawulence' start for di game with Foden wey drop first goal, as Haaland support am wit anoda goal for 34 mins. Man U never even recover for di second goal as Haaland drop di 3rd goal for 37mins. Ha! 'wetin dey sup'??? Na so all Man-U fans open mouth.

Before everybody rest say, enof is enof for dis first half, Foden add anoda goal join. Ha! Man-U don naked! Which kain international disgrace bi dis, ehn!?! E jus bi like say make all Man-U players disappear. Na one tin no make dia coach sef  enta ground.

Everybodi go rest for half time, make Man-U take reason dia life well. Antony for Man-U say, I'm know say Man-U don naked, but even if na jus pant, make den still wear, na so di guy score for 56 mins, Haaland look am say 'is this playin? What kind of playin?'

Halaand score third one to make am hat-trick. Foden look Haaland say, my guy, make me sef drop my hat-trick. Na so we reach 6-1.

Dey don almost dey share grace for di march before Martial con start like who dey train for Martial arts, score for 84 mins con still add anoda one for penalty wey happen for 90+1 mins.

Na dat one con make di match end for 6-3. Man-U coach con happy small say at least dem see pant and singlet wear, no bi say na ordinary 'blokos' Man-City

See di highlight for down so.







Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal