Mbappe appreciate free kick goal wey Messi score for dia match against Nice on Saturday.
On Saturday so, Lionel Messi net anoda free kick wey make im total career free kick goal enter 60.
For dis 2022/20223 season so, Messi dey hot like oven.
D free kick wey im score make Mbappe open mouth in wonderment as di guy jus dey clap for wia im dem for bench.
Messi don score 7 goals and 8 assist for di 12 games wey e don play dis season.
PSG first see one free kick for 12th minute, e dey about 30 yards from goal post, Messi play dat one go outside.
Di ogbonge one happen 15 minutes afta di first free kick wen PSG see anoda free kick. Dis one dey close to di goal post pass di first one.
E first bi like say na Neymar go play am but di Brazil man na Messi guy man, na so e leave di tin for Messi make e take am.
Di decision con bi beta one las las as Messi run am go angle 90.


Comments
Post a Comment