Sergio Ramos wife, Pilar Rubio wey bi Model and TV presenter yarn say na everyday she and her husband dey do kerewa
Sergio Ramos wife wey bi fine TV presenter plus model don yarn say na everyday im dey run show wit di PSG central defender.
Di former Real Madrid defender and im wife, Pilar, wey dia 4 children bi boys, marry for 2019 inside Seville Cathedral afta dem don dey date for 7 years.
Meanwhile, im husband wey don make name for himself as ogbonge defender enta news recently unto say e collect im 28th career yellow card for di match wey dem play against Reims.
Pilar, wey bi mama of 4 boys no shy wen dem dey ask am all dose kain questions.
She say na everyday show dey happen except wen she dey Madrid. She say her children no affect aw dem take dey run show as dem go don sleep for 9:30pm wey show go start.
Comments
Post a Comment