Super Eagles don drop for FIFA ranking afta dem lose dia match against Algeria
Di Super Eagles of Nigeria don drop go down by 1 for di latest ranking wey FIFA drop.
Nigeria dey numba 4 for Africa as dem dey back of Tunisia, Morocco and Senegal.
Naija coach, Jose Peseiro wit im boys go face Portugal and Costa Rica for November for international friendly match.
Nigeria wey drop from 31 position to 32 for di latest ranking wey FIFA put untop dia website on Thursday, October 6.
Nigeria wey bi African Champions 3 times drop for dis ranking small time afta dem lose 2-1 give Algeria for dia last game.
Nigeria bin start di game wit beta moraleas dem first score 1 before dem con dull allow Algeria equalize con still win dem join.
Senegal wey bi current champions for Africa dey numba 18 for di ranking.

Comments
Post a Comment