Tottenham hotspur coach don die

 Issue don happen for Tottenham Hotspur as dia fitness Coach don go meet im ancestors.

Dem say, Gian Piero Ventrone die suddenly afta e battle wit fulminant leukaemia for age 62.

As one message wey Tottenham yarn for dia social media tok:

"We dey devastated to gist una say our fitness coach, Gian Piero Ventrone don die." "Everybodi for our club go miss am, and our mind dey wit im family and friends dem for dis sad time"

Ventrone wey dem dey also call 'marine' die for Naples small time afta e sick.

Na 2021 Ventrone enta Tottenham when di club appoint Antonio Conte as di new club Manager.

We hear say Ventrone na person wey dey part of backroom staff wey Conte trust well well as dem bin don work togeda for Juventus.





Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal