Wetin happen for Champions League yesterday
Yesterday naim dem play di second set of match dem for Uefa Champions League.
Bi like some teams wey bin dey dull before don dey bounce back.
Na di games and di results dey down so.
RB Salzburg vs Dynamo Zagreb
Salzburg finally ensure say dem no dull mata for dia home yesterday. Even as e bi say Zagreb follow dem drag till 71 mins wey Okafor finally see net to put Salzburg for front of di game and top of di table.
Naim make dem see 3 points. Na dem dey enjoy di top position unto group E table now.
RB Leipzig vs Celtic
Leipzip show Celtic say oga na master and and say u no fit come dia house con dey do anyhow.
As Leipzig score first goal for inside 27 mins, Jota return dia own for Celtic for di first 3 mins inside second half.
Naim Silver vex say 'ehn ehn, una tink say we dey play abi?' sharpaly, di guy drop two hot goals between 15 minutes. Na so Celtic blood start to dey dry.
Chelsea vs AC Milan
Di oda day we report say one Arsenal legend say im dey pray say make Aubameyang flop
for Chelsea. Bi like say di guy prayer no work o as Aubameyang, wey dem dey call Auba goal for Arsenal dat year, dey part of di 3 guys wey disgrace AC Milan inside Standford Bridge yesterday.
Di vex wey Chelsea dey vex no bi small as dem wan use by force correct dia slow start. We hope say dem go fit sustain am.
Juventus vs Maccabi Haifa
Juventus no waste time at all as dem sharply drop 3 hot goals inside Maccabi bag.
Maccabi sef wan try do small tin as dem return 1 goal, Juventus sharply shut dem up say 'una no know where una dey?'
Real Madrid vs Shakhtar Donetsk
Vinicius Junior and Rodrygo naim do dem Shakhtar strong tin as dey quickly drop 2 goals inside first half.
Before first half finish, Shakhtar sef drop 1 wit hope say dem fit see anoda 1 but Madrid no gree dem.
Sevilla vs Dortmund
Na jejely Sevilla dey house dey try maintain demselves o, Dortmund no even get chills at all na rush dem rush di goals enta before Sevilla fit catch dia breath, net don tear!
Before Sevilla see road score 1, 3 don already enta. Di last goal enta for 75mins.
Benfica vs PSG
Messi wey bi say dey hot dis season still show am for UCL say im still dey hot o. Na inside first half Messi drop im goal fo di game as Benfica shock!
Na own goal wey Pereira score make Benfica see goal record, if not, na so PSG for jus carry 3 point comot dia bodi.
Man-City vs Coppenhagen
City still dey untop dia hot hot mata as dem begin goal shower for Man-U bodi on sunday. Na Coppenhagen collect dis time as dem drop 5 hot goals inside dia pant.
Di star boi, Haaland sef show im face and im shop unto say 2 out of di 5 goala, naim run am.








Comments
Post a Comment