Wetin happen for English Premier League Yesterday
Na di summarize of di matches wey happen in Sunday, 16/10/2022 dey here so.
Southampton vs Westham
Southampton sharply score Westham for inside twenty minutes make den for fit win di game without story.
Na as dem enta 64 mins for di match, Rice say no?! Make I cook small jollof for una make una rest. Na so e load dem beta equalizing goal wey con make di match end for draw.
Manchester United vs Newcastle
Newcastle find Manchester come house, nothing wey Manchester use dem do.
For di end of di game, two of dey united to draw. No oga for di mata.Leeds vs Arsenal
Arsenal still neva wan cool down for dis dia top position o, as dem dey try make sure say dem win all di games wey dey before league start to dey hard.
Arsenal find Leeds go house con reach dia go still lead dem wit goal from Bukayo Saka wey enta for 35 mins for inside first half.
Aston Villa vs Chelsea.
Chelsea sef nor wan rest for winning mata o. Di tin dey sweet dia new coach as dem go Aston Villa house go spread like say na Dem get di villa.
Aston villa hear am! E sound for dia ear two times. Mason Mount first drop di first goal inside 6 mins, still con top am wit anoda make sense goal inside 65 minutes to finally give Villa 'shut up' for di game.
Liverpool vs Manchester City.
Na di game of di day for on Sunday bi dis so as Man-City dey tink say na everywia wey dem reach Dem go fit jus dey 'haaland' everybodi.
Di game change yesterday as Liverpool nak dem beta original oriamo cord for neck. Na Salah provoke for di game say wetin happen sef?! Di guy carry beta koboko whip City inside 76 mins. Na Wetin make City belle less o, if not, Dem for still try 'Haaland' Liverpool for Anfied.
Comments
Post a Comment