Wetin happen for EPL on Saturday.
Na di gist of how mata take bi for games wey happen for Saturday for EPL bi dis.
Nottingham Forest vs Liverpool.
Liverpool bin dey reason say notin go fit ham dem for di forest wey den go play for on Saturday but dem lie!
Di mata shock dem as Awoniyi pour beta sand for dia garri to make Nottingham win di game wit im goal for 55 mins.
Everton vs Crystal Palace.
Everton no even waste time to show Crystal say no bi dia Palace den dey.
Na 3 hot goals Everton take show dem say e get why khaki no bi mate wit leather. Na from 11 mins Lewis start to dey roast dem crystal wit extra 2 goals wey still enta from Gordon and McNeil hand before match enta 90 mins.
Man-City vs Brighton.
Man-City no even give space for dia visitors to 'Bright' any 'Ton'. Haaland wey no dey use eye see net first tear dem di first goal for 22 mins
Before Man-City see penalty wey bi say na Haaland still take am, score am join before De-Bruyne top am for 75 mins. Brighton sef say make e no bi like say den no rep. Trossard sef tro 1 goal inside Man-City net for 53 mins to make everytin end for 3-1.
Chelsea vs Man-U.
Nor bi today dem Chelsea and Man-U bi like cat and rat. Dem no dey gree one anoda.
Despite say dem dey Stanford bridge, Man-U still follow Chelsea drag reach 87 mins wey Chelsea see penalty and Jorhinho score am.
Even Man-U tink say na so e go end before Casemiro return di equalizer for 90+4 mins to put di game for draw levels.
Comments
Post a Comment