Wetin happen for EPL yesterday plus highlights

 No bi small mata as e bi like say dis top position wey Arsenal dey don dey real o. Man-U sef dey show say, dem don dey wake up afta Man-City bin give dem uppercut last weekend.


Na di results of di games bi dis plus highlights.


Arsenal vs Liverpool.

Dis game tight yesterday as Arsenal open di floor for Emirates stadium wit goal from Martinelli for first minute. Liverpool equalize di goal as  Nunez score for 34 mins.

As if say dat one nor reach, Bukayo Saka score anoda 1 before half time break. For 53 mins, Firmino equalize again for Liverpool. Ha?! Nobodi wan gree! Na so Saka drop very hot puff puff inside Liverpool pocket as penalty sup for dem.



Na dat one Liverpool do do, dem no see am do finish wey con make game end for 3-2.

Everton vs Man-U

Everton see wetin Arsenal do for dia home yesterday, dem sef wan try am wit Man-U. For 5 mins na so  Iwobi go score o. 

Man-U shock! As di game enta 15mins, Antony score. Everton bodi rest.



 Anotony con get injury inside di game wey make di coach carry C. Ronaldo enta, as di guy enta, e nak anoda goal for Man-U inside 44mins to make am 1-2.


Westham vs Fulham

Na so Westham sef defend dia territory o as dem flog Fulham 3-1 yesterday.

Na inside 5 mins Pereira score for Fulham before Bowen equalize with penalty wey Westham see.


 2 more goals still enta from Scamacca and Antonio hand to seal di day for Westham.


Crystal Palace vs Leeds

For dis life ehn, hurry hurry no dey pay. Na Leeds dis mata still clear to again as dem go Crystal Palace house quickly score for 10 mins
Palace say, no wahala! For 24 mins, Edouard equalize before Eze con seal am for 76mins to make Palace bi winner for di game.



Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal