Wetin happen for Uefa Champions League yesterday + Highlights

 How una deyyyyyyyy???? Yesderday hot as e wan bi o as Chelsea trash AC-Milan again, 2 times inside one week naim chelsea dash dem 5 goals! Dem no even fit score any one back. Many many tins shelle yesterday for the games wey happen across Europe.

Di summarize dey down so.

AC Milan vs Chelsea.    08:00pm

Chelsea don go Milan to win AC hands down. Yesterday night hot as Chelsea show the Italians how e dey bi for London.

Jorhinho see penalty as Tomori use head carry red card before Aubameyang seal di day wit im goal for 34 mins.



PSG vs Benfica.    08:00pm

Bi like say na wetin follow PSG go benfica house still follow Benfica come PSG house.

Na Mbappe fess score before Mario return am. Na penalty di two teams see for di game.


Dortmund vs Sevilla.    08:00pm

Di game no eazi fo most teams yesterday as na draw still end dis game.

Na 1-1 w end as Bellingham and Nainzou score 1 goal each for dia team



Shakhtar Donetsk vs Real Madrid.  08:00pm

E no easy for Madrid as we tink say e go bi yesterday o.

Zubbkov score for Shakhtar for 46 mins before Madrid struggle see goal score, time don enta 90+5 mins



Coppenhagen vs Man-City  05:45pm

Na draw finish dia game as Coppenhagen make sure say City no see 3 points for dia city.

Man-City even collect red card join di mata wey dey ground.


Dynamo Zagreb vs RB Salzburg   08:00pm

Na anoda game wey end for draw yeaterday bi dis as dia scoreline give Chelsea upper hand to take dey top of di table for di group.

Salzburg bin win make dem retain dia top but Zagreb sef dey reason say hope still fit dey for dem.



Maccabi Haifa vs Juventus.    05:45pm

Maccabi use Juventus get dia 1st 3 points for dis competition.


Maccabi nak Juve 2 goals as Atzili score for 7 and 42 mins for di game. Na only 3 point both teams get now and na di 2 of dem bi like say dem no go enta next level so.

Celtic vs RB Leizpig.     08:00pm

Leipzig don comot for trenches for dia table as dem use  bitterleaf rub Celtic mouth yesterday


Na 2 beta goals dem nak Celtic, e con bi like say Celtic no go fit move from wia dem dey now.


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal