Wetin happen today for EPL games

 Dis Saturday so, na match day 9 for EPL and e get some ogbonge games wey happen today, one of dat kain game naim bi di North London Derby wey happen between Arsenal and Tottenham for 12:30pm for afternoon.


Arsenal            3
     vs                             12:30pm
 Tottenham     1

Tottenham shock today as dem enta one leg trouser wit Arsenal for wetin dem dey call North London Derby. 


Na Thomas Partey open di party wit goal for 20mins. As di mata dey go, Tottenham jam penalty, naim Harry Kane nak am enta net.

As second half start, Gabriel Jesus reason am say no, e no fit happen, na so di guy lunch anoda goal for Arsenal for 49mins before Xhaka go inside go bring Shakabula take kukuma destroy Tottenham. As e bi so, na Arsenal still dey ontop table dey run tins.

Liverpool       3
      vs.                             03:00pm
Brighton         3

Bi like say Brighton don dey wait Liverpool nor bi today.

Fans wey com watch di match never even sidon finish as Trossard tro di first goal for 4 mins, before Liverpool scream say ha! anoda goal enta for 17mins from dis same Trossard guy.

E con bi like say dem offend am before. Di tin vex Firmino say which kain tin, na so im sef drop 2 goals (33mins &54mins).

Di mata con block. E nor tey, na so Webster score own goal for Brighton. Ha! Di tin make Trossard feel very sad, say im struggle since don waste. But as man wey im bi, e correct di mistake of Webster for 83mins to make di game end 3-3. Liverpool eye bi wan se weeen but na one tin no make...

Fulham            1
    vs                                 03:00pm       
Newcastle       4

As game start, for 8 mins, Fulham sharply drop 1st goal unto say, na dem dey house.

Na so Newcastle vex o. Dem say na small tin dey always vex dem, say Fulham no allow match start before dem go dey score dey show off. 

Na so Newcastle load dem 4 goals o. Dem no even care say na away dem dey. Wilson, Almiron and Longstaff use vexation tear Fulham pant.

Southampton    1
      vs                              03:00pm
Everton               2

Southampton bin patient for first half, dem hold di goal, say make e no bi like say dem dey rush but wetin vex Everton na say, why una quick score for second half. Notin wey dey satisfy human beings o.


Na wetin make Everton drop 2 goals in 2 mins. 52mins and 54mins wey make di mata end for 1-2.

Crystal Palace    1
      vs                             03:00pm
Chelsea                2

Crystal Palace sef reason say make dem quick drop goals as na dem dey home.


Bi like say na almost all di away teams dem dey vex dis weekend. Na so Chelsea vex drop 2 for dia domot say, forget say you dey house, we nor bi your papa mate!

Bournemouth    0
          vs                          03:00pm
Brentford            0

Dis two teams respect each oda. I no see your yansh, you nor see my own, naim dem take am do as na 0-0 di match take end for Bournemouth house dis afternoon.


Na only for dia match goal no dey for EPL today.

Westham         2
    vs.                                 05:30pm
Wolves              0


Westham say make wolves no go reason am say away teams try today but dia own different.

Na Scamacca and Bowen run am.






Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal