Wetin happen yesterday for Champions League
As we know say na Tuesdays and Wednesdays na for Uefa Champions League for time wey dem dey play am.
Yesterday, tins happen for different cities for Europe untop Champions League mata.
Make we check am one by one.
Bayern vs Viktoria Plzen
Bayern no get pity at all. Dem jus run over Plzen like wen trailer run over chicken.
Di game dey part of di ones wey get goal pass for all di games wey happen yesterday.
Marseille vs Sporting.
Marseille stand gidigba for dia home say, notin dey happen!
As dem pass first pass, Sporting jus go score. Ha! Wetin happen?! Una no wan calm down abi?
Na so Marseille go open both di windows and doors of goals, use vexation finish Sporting. Red card evn join di gift wey Sporting collect before match end. Bi like say na oversabi kill Sporting.
FC Porto vs Bayern Leverkusen
Di game bi wan tight as nobodi score anybodi for first half. We dey tink say na she dem go dey drag until Sanusi port di first goal inside net for Porto.
Club Brugge vs Atletico Madrid.
Unto say Club Brugge dey house, dem show Atletico small shege.
Atletico no recover till referee blow final whistle. Na so di match end for 2-0.
Napoli vs Ajax.
Dis game brutal. Ajax no show human feeling for di game at all. Dem go visit person for house, beat am like thief wey steal for inside market.
Na dis game get goals pass for all di games wey happen yesterday. Na 6 goala di Visitor's take wile Ajax like oraimo cord for neck.
Inter Milan vs Barcelona.
Inter enta Barca wit 1 goal goal inside first half.
Barca try make e bi say at least draw go sup but inter stand wit dia goal say, 'for here'? Na so di game end 1-0.
Liverpool vs Rangers.
Arnold and Salah join bodi do Rangers strong tin for dia home yesterday.
As di game dey start for 7 mins, Arnolf first use goal welcome dem come Anfield before Salah com load di final goal of di day enta for 53 mins.
Eintracht Frankfurt vs Tottenham
None of dem gree for each oda o. As di game end for 0-0.
No winner, no senior for di game.








Comments
Post a Comment