Why dem no give Liverpool Penalty afta Gabriel hand touch ball for inside box 18 for dia match against Arsenal.

 Di match wey Arsenal and Liverpool play on Sunday bin get small confuse inside around 15mins for inside first half as Liverpool suppose get Penalty but las las, dem no give dem.

Liverpool launch penalty appeal afta Gabriel hand touch ball from cross wey Jota run inside box 18.

Di referee, Oliver, nor give di penalty even VAR sef support wetin di referee do as Liverpool fans vex say how can?

Premier League bodi con release statement as to why e bi say dem no give Liverpool di "penarity" for di match.

"Di closeness of players wen one person kick ball to di oda person still dey important to decide if ball na hand ball or not"

Wetin e mean bi say, di players dey too close, e no get way wey di oda person fit dodge di ball, so becos of dat, di ball no bi penalty


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal