Cristiano Ronaldo don go buy di most expensive villa for Portugal
Ronaldo aka CR7 don add anoda asset join im investments dem as im buy di villa wey cost pass for Portugal.
Di 37-year-old don buy $11 million dollar wey bi 3 storey, di villa get nice garden plus make sense swimming pool.
Di Manchester United striker naim bi di new owner of di $11 million dollar villa. Even as e bi say e nor dey di well ontop pitch, e bi like say e dey make sense outside pitch.
Di villa wey dey di region wey dem dey call Cascias go worth reach like $21 million after dem don some kind reconstruction and renovation untop.



Comments
Post a Comment