Haaland con dey hard to recognize afta di guy change haircut

 Di Man-City star, Erling Haaland don surprise fans wit im new hairstyle. Haaland wey bi say na unto injury mata di guy dey now, Im show face for one Halloween even wit im teammates dem.

Manchester City post some of di striker new hairstyle on social media and some sharp eye fans don sharply notice am.

Some of di fans surprise about di style while some dey beg make e no change am say dem like dis new style wey dem im head so.

Di Norway man don dey enjoy fine start since im transfer from Borrusia Dortmund dis summer.

Di guy hot as na from all angle e dey score from. So far for dis season as di season young reach, di guy don net 22 goals.

But right now, im get leg injury wey no allow am play against Leicester.

As di guy dey away from ball for now, e jus dey take care of imself so.



Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal