Viktoria Plzen don enta record as one of di team wey chop goals pass for UEFA champions league group stage

 No bi dia fault as di mata take bi o. Na group wey dem call, group of death den put dem for wit teams like Bayern, Inter Millan and Barcelona, di Czech republic club no fit see space breath.


As dem dey di group, for di whole 6 games wey happen, dem no see any one win. But at least dem don add join UCL history.

Apart from Plzen, 21 teams sef don see dis kain shege wey bi say dem no win any game at all for Champions League group stage. So dia fore, no bi only dem waka come.

For di 6 games wey dem play, dem concede 24 goals. Dis mata con make dem tie wit oda two teams wey don chop 24 goals for group stage like this (Legia Warsaw and BATE Borisov).


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal