Wayne Rooney send beta comment to Ronaldo even as e bi say Ronaldo criticize am
Rooney reveal am say im go like see say Ronaldo win dis World cup.
Dis gist by Rooney come even as e bi say Ronaldo jus finish explosive interview with Piers Morgan. For di interview, Ronaldo ya. Rooney say im dey always criticize am.
Wayne Rooney don admit say im go like make im former Manchester United teammate win dis world cup. E go sweet I'm mind if e happen.
Ronaldo wey enta interview with Piers Morgan dey provoke as I'm criticize many players wey dem bin play togeda for Manchester United including Rooney.
Ronaldo say im no get any respect for Man U manager, Erik Ten Hag as im still yab di owners of di club say dem no care about football.
Ronaldo tok say Rooney and Gary Neville dey jealous am. Im say e no know why Rooney dey jealous am maybe na unto say im career end for wen e jus dey enta 30 years but im still dey play for high level.
"I no go tok say I even fine pass am, sometin wey bi say, na true." Na Wetin Ronaldo tok.
Wen times of India interview Rooney and Dem ask am who e go like make e win di world cup, Rooney no tink am two times before I'm tok say, im go like see Messi or Ronaldo win am, as e go make beta sense to end dia make sense career.
Comments
Post a Comment