Wetin happen for Champions League yesterday (Group E) plus highlights

 As yesterday bi di last game for di group stage of Uefa Champions League dis season, plenty tins happen as na yesterday some teams finally sure say, dem don qualify and for some oda ones, na have a nice day or straight to Europa.

Di games wey happen yesterday:

Dis one na for group E.


AC Milan vs RB Salzburg.

Na 1 point AC Milan take dey lead RB Salzburg before yesterday game, dem understand say to lose dat match no bi option for dem at all.

Salzburg sef dey hope say, even if na 1 goal dem see take win, dem do qualify bi dat.

AC Milan no allow dem see road at all as dem drop beta 4 hot goals for dia lap before dem know wetin dey happen. Las las, n Europa Salzburg dey go join dem Arsenal and Man-U.


Chelsea vs Dynamo Zagreb.

Wen dis season Champions league start, na dis Zagreb pipo fess show Chelsea shege, pipo con dey tink say Chelsea no fit reach anywia for di competition.

Now, na Chelsea dey ontop di group table as oga as dem finish dia last group game wit 2-1 win untop Dynamo head.


Na Zagreb go house for di group as na de carry last.


Na how di table for dia group bi bi dis afta di last game.




Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal