Wetin happen for Uefa Champions League (Group F) plus Highlights
As yesterday bi di last game for di group stage of Uefa Champions League dis season, plenty tins happen as na yesterday some teams finally sure say, dem don qualify and for some oda ones, na have a nice day or straight to Europa.
Di games wey happen yesterday:
Dis one na for group F.
Real Madrid vs Celtic.
Madrid no even waste time wit Celtic before dem load dem goals to stamp dia level say na dem bi di oga for dia group.
Celtic chop 5-1 from Madrid hand for dia final match yesterday as dem don knock dem out for di game finally.
Shakhtar Donetsk vs RB Leizpig.
Leipzig go Shakhtar Donetsk house go shatter dem wotowoto. Na 4 solid goals Leipzig take show dem Shakhtar say, dem no bi dia mate.
Na from 10 mins goals start to dey flow in from various angles. Even Shakhtar sef join drop own goal for di mata.
At di end of di game, na how table bo for group F bi dis.
Real Madrid and RB Leipzig don finally enta next round as Shakhtar Donetsk struggle to qualify for Europa. Na Celtic carry last for di mata as dem no see anywia go apart from dia home.



Comments
Post a Comment