World cup result for yesterday and monday

Dis week Monday na serious business day for Africans for di world cup wey dey play so as  Cameroon see draw wit Serbia and Ghana flog South Korea.


Portugal vs Uruguay

Portugal make sure say dem no dull at all for di 2 games wey dem don play so far.


6 points don dey ground already for dem as dem dey top dia group and qualification don set for dem.

Highlight



Brazil vs Switzerland

Brazil win Switzerland for dis one as Casemiro score di only goal for di game near 90 mins.


Di South American country don ensure dia place already for next round wit dis win so.

Highlight



South Korea vs Ghana

Ghana make outstanding comeback as dem give South Korea back to back. S/Korea bin don dey lead 2-1 even as na Ghana fess score but Ghana equalize dem still come make sure say dem beat dem.

Di game na anoda boost for African countries for dis year world cup.

Highlight



Cameroon vs Serbia

Serbia and Cameroon no gree for each oda as na draw dem take finish.


las las Cameroon see draw for di game after Serbia bin don dey lead dem.

Highlight


Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal