World cup results for weekend

Di weekend tough for Qatar 2022 world cup as many tins shelle. Mighty teams no gree each oda.


Australia vs Tunisia

Australia rub pepper for Tunisia eye for weekend as dem beat di African team 1-0 to secure 3 points for demself.

For dis world cup, Tunisia Neva win any match so. Dia hope say den go reach next round don dey fade.

Poland vs Saudi Arabia.

Saudi Arabia don see who pass dem as Poland show dem shege. Dem beat Saudi as Zielenski and Lewandoski nak dem goals.

Saudi go dey hope say make dem see one more win for dia last game make Dem for take qualify to next round.

France vs Denmark

France show again why dem bi defending champion as dem show Denmark say oga na master.


Mbappe naim score di two goals and Christensen score one for Denmark.

Highlight





Argentina vs Mexico
Argentina win dia first game for di world cup as dem win mexico wit 2 goals. Messi and Fernandez score di two goals.


Argentina don get dia own 3 points now.

Highlight




Japan vs Costa Rica

Costa Rica fall Japan hand as dem score dem for 81mins.

E shock dem as dem dey reason say e fit end for draw but, Fuller fool dem wit im goal for 81 mins.

Highlight





Croatia vs Canada

Who sabi play ball sabi play. Football no bi Canada own abeg. Croatia teach Dem lesson as dem deal wit dem like teacher dey deal wit student wey dey prove stubborn.

Na Canada fess go score na Wetin provoke Croatia be dat.

Highlight




Spain vs Germany

Two odogwu for football mata play and none of Dem gree make di oda one see im back.


Na 1-1 Dem finally finish di mata.

Highlight





Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal