World cup results yesterday wit highlights


 World cup still dey continue hot hot as some teams wey normally person go use mind write off dey do big tins. Na Saudi first embarrass Argentina, now na Japan finish Germany.

Bi like say no big team again like that o and small team sef no wan dey dis world cup.


Belgium vs Canada.

Normally you go tink say Canada suppose chop plenty for Belgium hand but na lie, na one goal Belgium manage to score dem from di hand of Bashuayi.

At least Belgium don get 3 points for group F so.

Highlight



Spain vs Costa Rica

Oga na master o, who senior you don senior you and e nor get notin wey you fit do about am, na Wetin happen for dis match bi dat o as Spain use koboko wipe Costa Rica like say na loan Dem take come World cup.



7 hot goals for only one side make Spain di team wey don score di highest goals for dis competition so far.

Highlight



Germany vs Japan.

Anoda shocker happen yesterday as if to say di one wey we see on Tuesday between Saudi Arabia and Argentina neva reach!


Japan shock everybody as dem finish Germany yesterday evening. Di game tough no bi small, na Germany play pass but na Japan win am las las. E still come make am clear say, notin wey no fit happen for inside football.

Highlight



Morocco vs Croatia.

Na goalless draw dem take end dis one o. Di third of dis kain tin for di competition.

No bodi gree bow for di oda. Each or Dem don bag 1 point as dem dey hope say beta fit shelle for dia group.





Comments

Gists wey hot pass

Chelsea name go change to 'London cowboy'?

Wetin happen for English Premier League today with Highlight

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal